You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Harry Kane win 2026 Ballon d'Or as Alexia Putellas win women category
England and Bayern Munich forward Harry Kane don win di 2026 Ballodn d'Or award.
Di England captain and ogbonge Bayern Munich striker na di first English man to win am in 25 years.
Two-time Ballon d'Or winner and legendary ex-Brazil striker Ronaldo na im present di trophy to am.
Harry Kane also win di top striker award afta e score plenti goals for di 2025/2026 season for im kontri England and im club Bayern Munich.
Meanwhile, Alexia Putellas of Spain win di Women Ballon d'Or award and na 2001 Ballon d'Or winner Michael Owen present di trophy to her.
Alexia Putellas captain Barcelona to win four titles for di continent for 2025-26.
Barcelona win di Liga Femeni, Cope de la Reina, Spanish Super Cup and Champions League.
Putellas become Barcelona joint-second top scorer of all time afta she score two goals for di Champions League semi-final for May, and she also get di player of di tournament award.
Di two-time winner equal her former team-mate Bonmati record of three awards, sake of say she also be key part of Spain Nations League-winning side.
She describe di award as "'A great pride for me as captain".
Di 2026 Ballon d'Or award happun for di London Palladium Theatre wia dem crown di best footballers wit individual prizes.
Na di 70th edition of di Ballon d'Or ceremony wey recognise di best footballing talent for di world for di 2025/2026 season.
Dis na di first time di event dey happun for London. According to Uefa, London host am to to pay tribute to di first winner wey be Stanley Matthews of England wey win am for 1956.
France na im dey traditionally host di event evri year for Paris' Theatre du Chatelet since 2019.
Na France football magazine dey run am since 1956, and pipo dey see am well-well as di highest awards of individual prizes for professional footballers worldwide.
Di 69th edition produce Dembele of Paris Saint Germaine as di men winner and Aitana Bonmati as di women winner.
Full list of winners
Men Ballon d'Or winner (England/ Bayern Munich) - Harry Kane
Women Ballon d'Or winner (Spain) - Alexia Putellas
Men striker of di year (England and Bayern Munich) - Harry Kane
Women striker of di year (Mexico ) - Charlyn Corral, She be di first Mexican to get dis award.
Men club of di year (Spain) - Paris St-Germain - na dem win di Champions League last season.
Women club of di year (Spain) - Barcelona
Socrates Award winner (England) - Bukayo Saka na Arsenal and England forward Bukayo and na Nigerian musician Burna Boy wey also get football academy present di award of humanitarian work to am.
Men goalkeeper of di year (Spain) - Unai Simón - im be Spain and Athletic Bilbao goalkeeper.
Women goalkeeper of di year (Spain) - Cata Coll.
Men coach of di year (Spain) - Luis de la Fuente - e lead Spain to di World Cup title wey happun dis year.
Women coach of di year (Spain) - Pere Romeu - im be Barcelona Women team coach.
Men young talent of di year winner (Spain) - Lamine Yamal - na di third time Lamine Yamal dey win dis award back to back to back.
Women young talent of di year winner (Spain) - Vicky López - she win am for di second time back to back.
Men Ballon d'Or top 10 ranking
1: Harry Kane
2: Kylian Mbappé
3: Lamine Yamal
4: Rodri
5: Lionel Messi
6: Khvicha Kvaratskhelia
7: Ousmane Dembélé
8: Erling Haaland
9: Michael Olise
10: Fabián Ruiz
Women Ballon d'Or top 10 ranking
1: Alexia Putellas
2: Ewa Pajor
3: Khadija Shaw
4: Melchie Dumornay
5: Patri Guijarro
6: Caroline Graham Hansen
7: Pernille Harder
8: Claudia Pina
9: Alessia Russo
10: Temwa Chawinga