You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
See di biggest mosque for Africa wey cost $1billion to build
See di biggest mosque for Africa wey cost $1billion to build
Published
Algeria don build one of di largest mosques di world don ever see.
Di mosque fit accommodate ogbonge number of 120,000 pipo inside at once.
E get very tall tower wey dey nearly twice di height of di Pyramid of Giza.
Di mega-project also get library, a university, and a training centre.
But no be everyone for Algeria dey happy, and e get plenti criticism ontop how much di mosque bin cost.