You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
"My mama dey always ginger me"
Published
Di journey for mama and pickin to become Barrister start for 2011 wen dem get admission to different unversity for di same year. Di son, Barrister Nwadiogu Bernard talk say im mama, Barrister Nwadiogu Uchechi Onyekwere, dey among wetin give am more ginger to read and become lawyer. Wetin surprise people well-well be say di mama finish as di best graduating student for her set.