You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
President Buhari don finally tok about weda im be clone
Published
Nigeria President Muhammadu Buhari don finally react to rumour and tori wey don dey fly upadan say im be 'clone'.
Di president wey dey Poland for di 24th session of di Conference of di Parties (COP24) under di UN Framework Convention on Climate Change (UNFCCC), address di rumour wen im dey tok to Nigerians.
Im say some pipo bin wish make im die, wen im bin dey sick for many months.
"Na di real me… I go soon celebrate my 76th birthday and I still dey strong," im tok.