You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Nigerian Singer Simi don enter Billboard World Albums Chart
Published
Nigeria singer Simi don enter number five position for di US Billboard charts. She make di list with her debut album wey be "Simisola."
Billboard World Album Charts na big thing for music world; dem dey do dia chart based on how different albums dey sell, worldwide.
As di tori break out, Simi siddon talk to only BBC News Pidgin, about how she take hear say she don waka far.