You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Polaris Bank: CBN don carri leg ontop Skye Bank, withdraw dia licence
Published
Read am in 1 mins
Di Central Bank of Nigeria (CBN) dis evening announce say dem don takeover Skye Bank, withdraw dia licence and put new bank to take charge for now.
Di name of di new 'bridge bank' go be Polaris and na dem go manage all di gbogbotibo wey Skye Bank get.
Tori be say Asset Management Corporation of Nigeria (AMCON) go cari billions of naira put inside di new bridge bank, di CBN bin tok
As CBN dey prepare to announce say dem go withdraw di bank license, Skye Bank last post for for social media, na to greet "Friday", say dem happi to see am.