You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
National Assembly : Nigerians want lawmakers to make beta law for di kontri
Published
Nigerians don call on di 9th Assembly make dem work for di interest of ordinary pipo for di kontri.
Some pipo wey speak to BBC pidgin for Abuja Nigeria capital say dem want di lawmakers to chook eye for di electoral act and amend am wela so dat election for di kontri no go get K-leg.
Dem complain say di way wey lawmakers di shun plenary no good and dat dem want di Assembly to get discipline and work for di interest of Nigeria and di pipo of dia constituency.