You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Coronavirus: Ghana hospital workers wey dey sell PPE for dia personal gain unmasked
Published
One Africa Eye undercover investigation don show say some staff for Ghana hospitals dey sell Personal Protective Equipment (PPE) for dia personal profit.
More dan 2,000 medical workers for Ghana don catch coronavirus since di outbreak begin. Di kontri don see serious scarcity of essential protective equipment like face shields, masks and suits.
Di investigation show how some medical workers dey make profit at di expense of dia colleagues.