You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Waste to Fuel: Meet di young innovators wey wan solve Nigeria fuel palava
Four young innovators for Government Science and Technical college Garki Abuja come up wit invention wey dem hope go solve Nigeria fuel and electricity palava.
Umar Fadilat, Akalugwu Chibueze, Agbabiaka Adeola and Muktar Mas'ud dey turn plastic waste into fuel and cooking gas through di process wey science dey call pyrolysis.
Dem begin do dis research since 2018 and discover say fuel and cooking gas wey dem make from plastic waste dey cheap, clean and e no dey burn fast.
Dia plan na to build refinery and convert all di plastic waste for di kontri into fuel to put smile for di faces of ordinary Nigerians.
Producer: Faith Oshoko
Video: Chukwuemeka Anyikwa