BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Nigeria confam case of Ebola for FCT
Nigeria govment don confam one case of Ebola virus for di Federal Capital Territory (FCT).
Wia major Nigeria presidential candidates stand on petrol subsidy
Di tok-tok about weda to restore fuel subsidy or not don dey dominate political discussions ahead of di 2027 general elections. Hia na wetin di major candidates dey tok about am.
'I wan clear my name' - Ghana headmaster withdraw from election afta alleged sexual abuse of school girls
Obuasi high school headmaster Zakaria Abdulai dey interdicted as im face multiple allegations of sexual abuse against his students. Im now resign as NDC constituency secretary afta public backlash.
Court find Kenya pastor Paul Mackenzie, 29 odas guilty of murder of 190 children
Prosecutors say Paul Mackenzie bin lure di latest victims to dia deaths by writing notes from im prison cell.
Former Delta State govnor Emmanuel Uduaghan die at age 71
Uduaghan, wey govern di south-south state from 2007 to 2015, die on Monday, 19 October, im family announce.
'We bin tink say na just monkey tail' - Di local alcoholic drink wey bring death to a community
BBC News Pidgin enta Araromi-Obu, one community for Ondo State, southwest Nigeria to tell di tori of di mystery of di sudden deaths.
Wetin dey ginger kasala for France as protests turn to looting and violence
Videos show as pipo dey throw fire for di capital, Paris while pictures show as police dey spray tear gas for Marseille.
Who be Katie Zacharia wey no last five days as White House Press Secretary
Zacharia collect heavy criticism for her first press briefing on Tuesday, wey last less dan 15 minutes and na only three questions reporters ask.
Tinubu appoint six new top Inec officials
Dis announcement dey come exactly three months to di 2027 general elections wey go start on 16 January.
Special Tori
'Tap water no dey safe' - South Africa warn residents afta ova 400 fall sick
More dan 400 pipo, mostly children under four, fall ill afta dem drink contaminated water.
Nigerian man chop eight years prison sentence for US ova hacking, fraud and identity tiff-tiff
US District Judge Paul G Gardephe na im sentence di Nigerian citizen wey im alias na Chukwuemeka Victor Eletuo and So Kwan Leung.
Nafdac reveal wetin cause death of NYSC member for Enugu camp, Senate demand investigation
Nafdac wey carry out preliminary clinical assessment, tok say di suspected cause of death of di NYSC member na 'acute kidney injury secondary to severe dehydration and shock.'
Wetin Ecowas and Alliance of Sahel States (AES) cooperation discussion mean for West Africa
Di Alliance of Sahel States (AES) and di West Africa regional bloc Ecowas don agree to establish one joint working group wey go develop ogbonge cooperation framework agreement wey go guide future relations between Ecowas and di AES.
Rivers State police suspend officers afta alleged cultists renovate station
Video clip wey go viral on social media show as some young men alleged to be cultists gada to inaugurate di renovated police post, and even pose for foto wit di officers.
Five types of phones NCC say go stop to dey work for Nigeria
NCC explain say di new system na part of dia plan to improve di standards for verifying communication devices, so as to stop di spread of fake phones and protect di safety of pipo wey dey use dem for Nigeria.
All you need to know about new Suicide (Prevention) Bill Nigeria senate dey consider
Di Nigeria Senate President bin cause tok-tok for social media sake of im comment durin di debate ova one new bill to decriminalise attempted suicide for di kontri. But wetin dis bill dey tok?
Suspected scammers for Nigeria, Ghana chop arrest for joint operation across West Africa
Authorities say dem arrest 19 pipo for Ghana and nine for Nigeria. Dem also seize 356 electronic devices plus identify at least $11 million in potentially recoverable funds.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.















































