You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Meet Michael Akoma, di one hand keke driver
Published
52 years old Michael Akoma na keke - tricycle driver for Lagos state south west Nigeria.
But e dey drive wit one hand.
Akoma involve for one truck accident for 2015 wey land am for hospital with serious injuries wey result to amputation.
E tok to BBC Pidgin about di pain and challenge of doing im job wit only one hand.