Nigerian govment approve 90 days economic action to reduce cost of living - wetin e mean

Published
Read am in 3 mins

Di Federal govment of Nigeria don approve 90 day economic plan wey dem say go reduce di cost of living for Nigerians.

Nigerian govment take dis decision di National Economic Council meeting on Thursday, 22 October during d wey di Vice President Kashim Shettima chair.

Di economic council approve di 90-day action plan wey di Federal Ministry of Finance bring.

According to one statement wey one of di tok-tok pesin to di Vice President Stanley Nkwocha issue, na di Minister of Finance Taiwo Oyedele present di plan bifor di national economic council

Dem say di economic plan go focus on how to reduce di cost of living, make food affordable for Nigerians and attract investment across di kontri.

According to di 90-day proposal, dem also wan use am speed up projects wey go bring direct benefits to Nigerians.

Wetin di 90 days economic plan mean

According to di plan wey Minister of Finance Oyedele present bifor di national economic council na five area of priorities dem wan focus on.

DI five areas include:

  • Food affordability
  • Tax harmonisation
  • Completion of important projects wey go get direct impact on pipo
  • Solving problems wey dey stop investment from entering Nigeria
  • Plus providing regulated support for households.

Di council also approve di establishment of one national dashboard wey go track projects across di kontri, wit emphasis on transparency and accountability.

Di dashboard go also report how dem dey use di profit from fuel subsidy removal.

Oyedele say di reduction of headline inflation and interest rates to single digits by 2027 dey key to di policy.

E say dis economic plan go benefit households and businesses, and e go also help comot any challenges wey investments dey get.

During di Council meetin Vice President Shettima tell state govnors and relevant govment institutions make dem ensure say di gains of di administration economic reforms become 'affordable transportation, improved healthcare, employment opportunities and greater financial security for Nigerians.'

E say di success of di economic plan go dey decided by how e get impact on di daily lves of citizens.

"Di first dividend of prosperity suppose be di confidence to plan life. Our task na to make such confidence less dependent on fortune," Shettima say.

According to di Vice President, di NEC deliberations on transportation, healthcare, police reform, and livestock development represent important decisions about di quality of life wey Nigerians suppose expect from economic progress.

"Di cost of reaching livelihood no suppose consume di livelihood itself. Di passenger experience must guide our ambition, becos di value of public transport na di kain journeys e make possible.," Shettima tok.