President Ramaphosa approve salary increase for public office holders and judges

Published
Read am in 3 mins

South Africa President Cyril Ramaphosa don increase di salary of public office holders and judges for di kontri.

For one statement on Tuesday, 10 November, di South African leader announce say im dey increase dia salary for di 2026/27 financial year, effective from 1 April 2026.

E say im dey increase di salary of public office-bearers by 3.5% and 4% for different categories, and 4% salary increment for judges of di Constitutional Court, judges of oda courts, and magistrates.

"Di increment follow di recommendation of di Independent Commission for di Remuneration of Public Office-Bearers, plus di president consideration of di serious economic challenges wey dey face di kontri," Ramaphosa tok.

E add say, "di Independent Commission for di Remuneration of Public Office-Bearers dey mandated in terms of section 219(1), (2) and (5) of di Constitution, read wit section 8(4) of di Independent Commission for di Remuneration of Public Office-Bearers Act, 1997 (Act No. 92 of 1997), to make annual recommendations wey relate to di salaries and/or di upper limits of di salaries, allowances, and benefits of di public office-bearers," di statement tok.

Who be di beneficiaries?

President Ramaphosa say di increment of di salary go fall under different categories, as some go receive 3.5%, odas go receive 4%.

  • Members of di National Executive
  • Members of di National Assembly
  • Permanent Delegates to di National Council of Provinces
  • Premiers, members of provincial executive councils
  • and members of provincial legislatures.

Dis categories go receive 3.5% salary increase, while judges of di Constitutional Court, judges of oda courts, and magistrates go receive 4% salary increasement.

Oda pipo wey fall under di 4% increase na:

  • Traditional leaders,
  • Members of di National and Provincial Houses of traditional
  • Khoi-San leaders
  • Members of independent constitutional institutions go also receive a 4% increase determination.

Di salary increment dey come afta di African National Congress, di ruling party for South Africa record dia worst-ever result for local elections since Nelson Mandela lead di kontri out of apartheid and into democracy more dan 30 years ago, result wey di party call "catastrophic".

While dem win di most votes out of all di parties for di kontri, ANC win 31% of di overall vote, one third down from di 46% dem gain for 2021, and a far cry from di 65% dem get 20 years ago.

Di story of dia decline dey very clear for provinces and cities. Di party bin win majority for just one out of di kontri nine provinces, Limpopo.