You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Ghanaian twin brothers plead guilty for $9million romance fraud wey target old US citizens
Twin brothers from Ghana don plead guilty for dia role inside one ogbonge romance fraud wey reportedly lead to $9m losses from older US citizens.
Di US Attorney's office for Northern District of Ohio for dia press statement confam say one American woman also bin plead guilty as part of dis scam.
All three pipo according to US authorities dey part of conspiracy to commit wire fraud wey target victims for Ohio and 24 oda states.
22-year-old Jamal Abubakari aka 'Arrangement' and im twin brother Kamal Abubakari aka 'Lancaster' plead guilty for 13 October togeda wey dia co-conspirator 53-year-old Amanda Joy-Boachie aka Amanda Joy Kessei plead guilty for 20 October.
Court documents bin show say di three pipo from July 2024 to April 2026 don target dia victims on top dating websites and social media platforms to engage for dis romance scams.
"Di defendants now conspire wit odas to use fake profiles to create close and personal relationship wit dem bifor di victims begin to send money to dem thru financial accounts wey dia co-conspirators bin dey control," di US Attorney office explain.
Dem add say "dem send some of di money to Ghana and oda places, di victims bin lose more than $9m."
Di three defendants – di twin Abubakari brothers and dia co-conspirator Joy Opoku-Boachie "gree to forfeit di expensive jewelleries wia investigators bin seize during dia arrest."
Dis include luxury watches, rings, chains, medallions and earrings.
US authorities confam say FBI Cleveland division bin lead dis investigation wey dem collaborate wit Ghana authorities including di police and Attorney General office.
Di oda agencies wey involve for dis case na di kontris Economic and organised crime office (Eoco), Cyber security authority (CSA), di Narcotics control commission and di financial intelligence center.
Ghana immigration, national intelligence bureau also bin provide support.
Di three pipo bin dey face up to 20 years for prison.
"Federal district court judge go use di US sentencing guidelines to sentence Jamal Abubakari aka 'Arrangement' and im twin brother Kamal Abubakari aka 'Lancaster' for 9 February 2027."
Dia co-conspirator 53-year-old Amanda Joy-Boachie aka Amanda Joy Kessei go sabi her own sentence for 10 February 2027.
Who be dis twin brothers wey dey face up to 20 years for jail
On top dia social media page, dem describe diaserf as musicians.
In fact, dem post some of dia songs on top dia pages – for tiktok, some of dia music videos bin clock between 500k and one million views.
Inside some of di videos on top social media, di twins bin flaunt luxury cars, houses and cash.
Some pipo bin describe dem as socialites wey dem bin dey associate wit some of di ogbonge musicians for di kontri.
One of dia songs wit di title 'Business is Business' wey feature Iceboy IBM get ova 100k views on top dia YouTube channel.
For May dis year, US authroities bin announce say dem gbab di twin brothers togeda wit Amanda Joy Kessei for Virginia, afta dem arrive for di kontri.
Tori be say dem bin use fake business deal to trick dem to enta di US wey dem chop arrest afta FBI and oda agencies bin monitor dem for long time.
Dem carry dem enta custody afta dat arrest wey dem bin dey face roman fraud and conspiracy charges.
Oda Ghanaians wey dey await sentence afta pleading guilty
Di Abubakari twins no be di only Ghanaians wey don enta di net of US authorities ova fraud and romance scam wahala.
In fact, one popular Ghanaian businessman Joseph Kwadwo Badu Boateng aka 'Dada Joe Remix' bin also plead guilty to conspiracy to commit wire fraud for early dis year.
Im dey part of one ogbonge network wey bin allegedly defraud US citizens thru romance scam
Police arrest 'Dada Joe Remix' on 27 May 2025 wey dem extradite am to di US, im dey for custody since di arrest.
Authorities say 'Dada Joe Remix' lie im victims say im get family inheritance of gold and oda jewels, wey im demand money to pay taxes to release di items to di victims.
Afta im plead guilty, 'Dada Joe Remix' also gree to pay back $4.4m.
US District Judge Angela Martinez for sentence di Ghanaian for 8 September 2026 bifor.
But up to dis time for October, dem no yet announce im prison sentence.
E neva dey clear when dat judgment go happun.
Abu Trica dey face trial afta dem extradite am to di US
Apart from dat, for 9 July 2026, Ghana authorities extradite popular socialite Frederick Kumi aka Abu Trica to di US to face romance scam and fraud charges.
According to di US attorney office, Abu Trica also be part of one criminal network wey target elderly victims through romance scams and defraud dia victims of up to $8m since 2023.
Ghana police bin arrest di 31-year-old for 11 December 2025, months afta tori spread say im dey ontop FBI and Interpol radar.
Abu Trica dey bifor US district court for di Northern district of Ohio bifor judge John Adams.
Prosecutors say im togeda wit oda pipo use technology and Ai to create fake identities wey dem carry run romance scam network wey allegedly target ova 80 US citizens wey dem tiff ova $8m between April 2023 and November 2025.
Abu Trica don plead not guilty to di charges - di trial go soon begin for dat case.