Boat accident for Senegal kpai ova 21 pipo as dem dey run go Europe

Published
Read am in 3 mins

At least 21 pipo don die afta one boat wey carry migrants wey dey try travel go Europe capsize for coast of Kébémer for northern Senegal.

Dis na according to information from Senegal Interior Ministry even though some local tori pipo bin report say di death toll fit pass dat number.

Di ministry tok say rescue teams recover 21 dead bodis and save one pesin afta di boat sink on 7 November.

Authorities add say search and rescue operation still dey continue as officials dey find possible survivors.

State-owned Senegalese Press Agency (SPA) report say rescuers recova 35 bodies, but BBC neva independently confam dat number.

Tori comot wey indicate say di boat bin dey travel through Mauritania as e dey go Canary Islands for Spain.

Dis na one route wey many migrants from West Africa dey use to try enta Europe.

Senegal interior minister to visit scene of boat accident

Senegal Interior Minister, Mouhamadou Makhtar Cissé, dey expected to go visit di area on Monday to sympathise with families of di victims and communities wey dis gbege affect.

Di Interior Ministry say different govment agencies don join efforts to continue di search operation, rescue anybody wey still fit dey alive and provide support for affected families.

Senegal President, Bassirou Diomaye Faye, don also send condolences give families of di pipo wey die for di incident.

Govment officials also repeat say dem dey committed to fight human smuggling networks through stronger cooperation with neighbouring kontris.

Dem also draw ear give pipo saymake dem understand di risks and dangers wey dey inside irregular migration.

Spain react to increase in irregular migrants

Dis latest tragedy happun as more migrants dey again try to go di dangerous journey to di Canary Islands, wey still be one of di main entry points into Europe along di Atlantic migration route from West Africa.

Authorities for di Spanish archipelago declare emergency on Saturday afta sharp increase for migrant arrivals, especially for El Hierro Island.

According to local authorities, more dan 3,300 migrants don arrive for di island on top like 30 boats since di beginning of November.

Officials don call for more assistance from di Spanish govment to help accommodate di new arrivals.

Storm wey dey come also expect to make di sea crossing to dey even more dangerous for migrants wey still dey travel on di road.

Data from Spain Interior Ministry show say 13,327 irregular migrants enta di Canary Islands by sea between January and October 2026.

In recent weeks, tighter patrols around di coasts of Senegal, Mauritania and Morocco don force some migrants to start dia waka from kontris wey dey farer for south.

Dem include Gambia, Guinea-Bissau and Guinea. Sabi pipo say dis change dey make di trips to dey longer, riskier and more deadly for di pipo wey try am.