Chris Brown sentenced to prison ova London nightclub attack

Published
Read am in 5 mins

US singer Chris Brown, don chop prison sentence afta court find am guilty for fight wey happun for one London nightclub.

Chris Brown face Southwark Crown Court as e plead guilty to fighting charges.

Court sentence am to eight months in prison, wit 12 months suspension.

Im co-defendant Omololu Akinlolu get four months in prison, wit 12 months suspension.

Brown appear for court alongside 40 years old rapper Akinlolu, wey also admit to di charges.

Dis means say dem no go go prison for now, but if dem dey convicted for anoda offence within di stipulated year, dem go serve am togeda.

Crown Prosecution Service (CPS) describe di attack on music producer Abraham 'Abe' Diaw as "vicious and unprovoked," and Diaw need hospital treatment afta im injuries.

Di incident happun for Tape venue, one private members' club for Mayfair, in di early hours of 19 February 2023.

Brown, 37, na one of di biggest music stars for di world, wit many hit songs including With You and Forever.

While delivering di judgement di judge tell Akinlolu say im culpability dey lower dan Brown, as dei prosecution don agree say im no carry or use bottle.

Di violence na use of punch and kick wey im direct to Diaw wen Diaw dey ground.

Di judge still consider say Akinlolu pursue Diaw wen Diaw try to move comot, and say di fact say di attack happun for "crowded" and "tight" place.

Di judge tok say Akinlolu no start di violence, na only afta e don start im join, but im role still dey "significant."

Di judge tokm say im sentence go dey "distenctly belowr" pass im impose on Brown.

Brown no dey entitled to special treatment becos of 'fame' - judge

Di judge tell Brown say e play "leading role in dis joint offending," di judge tok say im go take dat into account wen e sentence am.

E tok say Brown get "two previous convictions wey involve violence", dating back to 2009 and 2013. Dis one dey "relevant becos of di nature" but dem "don old now", e tok.

E add say Brown don dey under bail conditions for "long time", and add say e consider how Brown dey comply wit di bail conditions.

Oda factors wey di judge take into account be say Brown na father of four pikin, and di impact wey custodial sentence fit get for dem.

Also im "stable employment" and "charity work".

But e emphasise say Brown no dey entitled to special treatment becos of im "fame, commercial success, and professional standing".

E add say Brown pre-sentence report make am at risk to commit more crime.

Wetin Chris Brown lawyer tok

Chris Brown lawyer ask di court make dem consider di singer "good and law-abiding life" as mitigation.

Defence lawyer Sallie Bennett-Jenkins tok say Brown previous convictions don pass many years ago, and say e "deeply regret" di nightclub incident, as e offer "profound apology."

She tok say Brown na "positive, loving, present and committed father to all im pikin dem."

"Dis na ugly and unattractive incident," Bennett-Jenkins tok.

"But dis incident short, e last for about 17 seconds but may more dan 20."

"Na sometin wey undoubtedly go cause distress to pipo wey dey present and for Mr Brown... e offer profound apology to di pipo wey dey present."

Court show CCTV video of di attack inside courtroom

Inside di courtroom dem show three CCTV clips wey dem take inside Tape nightclub on di night of di attack. Di footage na total of two minutes 23 seconds.

Di attack last for 20 seconds, but Chris Brown hit di victim, Abe Diaw, four times wit tequila bottle, twice for im head.

Prosecutor, Heidi Stonecliffe KC, describe di weapon as "heavy square shaped tequila bottle" and tok say Brown approach Diaw around 03:00.

Di footage show say di nightclub dey very small and dem pack am full.

Chris Brown dey watch from di dock. Im face dey motionless.

Dem go release di CCTV footage to dei public afta di sentencing.

Wetin Chris Brown plead guilty to?

Chris Brown plead guilty to 'affray' for Southwark Crown Court in July dis year.

E suppose face trial for more serious charges, wey im bin deny, but dem later drop am.

Assault, attempt to cause grievous bodily harm, and carrying offensive weapon na di charges im suppose face.

Brown vocal coach, 40-year-old rapper Omololu Akinlolu, also plead guilty to affray, and dem drop di assault and attempted grievous bodily harm charges for dem.

Di offence relate to attack on music producer Abe Diaw for club for Mayfair, London, on 19 February 2023.

Wat next for Chris Brown?

Afta di sentencing, Chris Brown pass di midst of media and fans as e comot Southwark Crown Court.

Di US singer no address di media but im blow kiss to im fans as im enta im vehicle.

Each of defendants get custodial sentence - e mean say dem no go go prison immediately - but if dem dey convicted of anoda offence within di time period dem suspend dia sentence, dem dey likely to serve di custodial sentence in addition to di sentence for di new offence.

"Each sentence na one of 12 months or less - by law I dey required to suspend each custodial sentence unless you be excluded offender or I dey satisfied say na exceptional circumstances relating to di offence or di offender justify di immediate custodial sentence," di judge tok.