You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Who be suspected Chinese spy wey chop accuse say she get affair wit Nvidia CEO
One of di Artificial Intelligence (AI) industry most important figures don chop accuse say e get affair wit one suspected Chinese spy, and e don lead to investigation.
US intelligence officials believe say Chinese businesswoman Alice Huang, wey bin get close relationship wit Nvidia CEO and co-founder Jensen Huang, na spy for Beijing, according to one New York Times report.
On Sunday, Huang bin admit say im dey "unfaithful" to im wife and apologise for hurting her and dia children.
Jensen Huang for statement tok say im take "full responsibility" for wetin e do, and add say im don fall short of im responsibilities to Nvidia employees, board and shareholders.
US tech giant Nvidia, one of di most valuable companies for di world, don open independent investigation into di reports.
Di company say dem no believe say US national security dey compromised - and dem add say Huang dey committed to continue to dey lead di company.
Hia na wetin we know about di affair and why e mata.
Who be Alice Huang and wetin we know about di affair?
US officials believe say na China top intelligence agency employ Alice Huang, according to di New York Times.
Her current whereabouts no dey known.
Alice Huang, wey no get any relation to Jensen Huang, na top executive for Singapore-based data centre firm Megaspeed between March and November 2023.
Pipo binsuspect say di firm dey help divert Nvidia chips go China, mata wey Nvidia tok say dem investigate and debunk.
However, BBC understand say Singapore govment dey investigate Megaspeed on top previous allegations say di company dey avoid US sanctions on di export of Nvidia high-end chips.
Di company tell New York Times last month say di current leadership take di allegations seriously and don appoint external legal advisers to carry out internal investigation.
Surveillance reportedly reveal communications between Alice Huang and one American citizen, wey dem later identify as Jensen Huang through one process known as "unmasking".
E neva dey clear, di kain intelligence wey Alice Huang – wey also dey known as Huang Le – fit don allegedly gada give Beijing.
She no respond to di paper request for comment.
We dey investigate - Nvidia
For inside one separate statement wey Nvidia board of directors issue, dem say dem go begin investigation in "light of recent report say founder and CEO Jensen Huang na di target of foreign intelligence effort".
"Di Board dey prioritise US national and economic security, wey dey most important to di interest of Nvidia and di shareholders.
"While di Board no get any reason to believe say either national security or Nvidia secrets bin dey compromised, di Board inquiry go examine all available information," dem tok for di statement.
US President Donald Trump for im reaction tok say im neva follow Nvidia boss tok since tori of di investigation come out.
"I just know say im na fine pesin, but you no go fit know wetin dey go on," Trump tell reporters, e add say e don "do amazing job for our kontri".
Di New York Times bin report for late October say dem brief Trump last year on intelligence wey allege say Alice Huang dey spy on behalf of China.
Reporters ask am on Sunday weda im dey wish now say im "act on di intelligence" at di time, Trump reply say: "No, I no tink so. I tink say na honourable guy."
Secretary of State Marco Rubio, meanwhile, refuse to comment wen dem ask am about Huang bifor flying to Paris for meeting of di G7.
Rubio tell di press: "I no go fit comment on any of dat. I no go fit comment becos of di nature of am. And I no go fit also comment on di internal corporate mata wey dey go on wit Nvidia, as you highlight, I no sabi anytin about dat part of am too."
Who be Jensen Huang?
Dem born am for Taiwan for 1963. Huang na nine years old wen im family relocate go di West Coast of US.
E graduate as an electrical engineer from Oregon State University, e also get master's degree for di same field from Stanford University.
Huang later work for one US chip firm AMD bifor e co-found Nvidia. Known as "Daddy Huang" for Taiwan and pesin wey pipo bin hail one time as di "Taylor Swift of tech", e get reputation as a workaholic and perfectionist wit incredibly high standards for im staff.
According to di Bloomberg Billionaires Index, e get estimated fortune of $155bn (£115bn).
"Jensen Huang na tech visionary of di likes of Steve Jobs," Stephen Witt, di author of Thinking Machine, one biography on Huang, tell BBC, and add say e dey responsible for creating AI hardware as we know am today.
Huang dey close wit Trump. For di recent AI summit for di White House, wia 42 tech executives bin dey present, di president bin dey for di middle of Elon Musk and Huang.
Wetin be Nvidia and how important e dey?
Founded by Huang and fellow electrical engineers Chris Malachowsky and Curtis Priem for 1993, di company originally dey known for chips wey dey process graphics, particularly for computer games.
E later change focus to AI, one field wey e take dey dominate now.
Jensen Huang bin rescue Nvidia from bankruptcy on more dan one occasion, and im bin take risks on AI long time bifor di rest of di world enta AI.
Im decision to make Nvidia chips, originally designed for gaming, wey becom di best for di business for AI development, don pay off now in well-well and di company worth trillions. Dis na big blow for di man wey pipo sabi as workaholic, perfectionist and someone wey expect incredibly high standards from im staff.
Nvidia na central player for AI infrastructure, wey dey provide chips to leading AI model developers including OpenAI and Meta.
Di microchip manufacturer dey worth some $4.5 trillion, wey make am one of di most valuable companies eva.