You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.

Carry me go di main website

Ajayi and Lookman goals power Nigeria past Tanzania

Semiu Ajayi header and Lookman strike power Super Eagles past Tanzania for Afcon 2025 match.

Summary

  • Nigeria sama Tanzania 2-1 for dia opening game for Group C
  • Na Semi Ajayi first score for Nigeria bifor Ademola Lookman top am
  • Charles M'Mombwa net di only goal for Tanzania
  • Di victory na Nigeria fifth ova Tanzania for eight matches across all competitions
  • Tanzania neva defeat Nigeria although three of their encounters bin end for draw

Live Coverage

Tunde Ososanya and Adesola Ikulajolu

Welcome!, Nigeria vs Tanzania

Time don reach for Tanzania and Nigeria to lock horns for di ongoing Africa Cup of Nations.

Di Taifa Stars of Tanzania go hope to pour sand sand for di Super Eagles garri as di two of dem go meet for di opening match of Group C.

Welcome to our live-text coverage of dis ogbonge clash.