You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.

Carry me go di main website

Twitter carri madam Oby mata for head as she go S/Africa

Di former Nigerian minister attend di World Economic Forum for Cape Town afta Nigeria gomen bin pull out.

Live Coverage

Nduka Orjinmo

  1. Tiwa Savage cancel her performance for South Africa

    Ogbonge Nigerian singer and songwriter Tiwa Savage don cancel her performance for di DSTV delicious Festival wey dem wan do for Johannesburg, on di 21st of September because of di recent xenophobic attack against Nigerians, wey dey stay for South Africa.

    Tiwa Savage post for her twitter handle say, di killi-killi of pipo inside South Africa dey very bad and she no go gree watch dat kain tin.

    �9;M��7�

  2. Una good morning

    Una welcome to our live page.

    We go bring una di latest reactions, actions and everything wey dey happun since di latest xenophobic attacks against Nigerians and oda foreign nationals wey start over di weekend for South Africa.