You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.

Carry me go di main website

Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. See how Macron second term begin for Elysee Palace

  2. How Russian billionaires and businessmen dey run go Dubai to avoid sanctions

  3. Russia claim say Ukraine 'kill dia own civilians' for Kherson

  4. Wetin Zelensky and South Africa President Ramaphosa discuss for phone call?, Ukraine President don dey reach out to world leaders for support

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Ukraine President Volodymyr Zelensky do phone call wit di President of South African Cyril Ramaphosa on Tuesday evening.

    For one tweet, Mr Zelensky say den tok about di resistance of im kontri to di invasion by Russian troops.

    Dem also discuss about relations between di two kontris and co-operation wit international organisations.

    Di Ukrainian president don dey reach out out to global leaders and regional blocs to beg for world support.

    Mr Ramaphosa office neva give any statement about di phone call.

    South Africa dey among 17 African nations wey no vote for United Nations resolution wey dey demand an end to di Russian offensive for Ukraine.

  5. Gunmen kidnap more dan 70 pipo for northwest Nigeria

  6. 'Dis Ramadan dey full of pain' - How Ukraine Muslims dey fast

  7. Why Russia ban UK Boris Johnson, senior ministers - See list

  8. Three ways war for Ukraine fit escalate

  9. Boris Johnson meet President Zelensky - See wetin dem discuss

  10. US explain why dem sanction Putin daughters

  11. How much of di world dey rely on Russia for oil and gas?

  12. Chelsea owner Abramovich suffer suspected poisoning

  13. Wetin be di security Measures dem dey take to protect President Putin

  14. Russia aim to divide Ukraine - intelligence chief

  15. Second Niger bridge near completion

    Di completion of di Second Niger Bridge wey link Anambra and Delta states for Southern Nigeria don dey near.

    Dis na according to Nigeria federal goment wey say di project don reach 91 per cent completion.

    Minister of Works and Housing, Babatunde Fashola tok dis one during di special weekly ministerial briefing for State House, Abuja on Friday.

    E say di “206 billion naira project don employ 1,486 pipo wit 8,110 indirect jobs”.

  16. Second Niger bridge near completion

    Di completion of di Second Niger Bridge wey link Anambra and Delta states for Southern Nigeria don dey near.

    Dis na according to Nigeria federal goment wey say di project don reach 91 per cent completion.

    Minister of Works and Housing, Babatunde Fashola tok dis one during di special weekly ministerial briefing for State House, Abuja on Friday.

    E say di “206 billion naira project don employ 1,486 pipo wit 8,110 indirect jobs”.

  17. 10 key events during one month of Russia invasion of Ukraine

  18. Putin critic Navalny chop nine years in jail wey pipo condemn

  19. Rafael Nadal out for up to six weeks wit rib injury

    Rafael Nadal no go dey available between four and six weeks afta e suffer a stress fracture of di rib.

    Di injury occur on Saturday during di Spaniard win against Carlos Alcaraz for di Indian Wells semi-final.

    To breath begin hard dey hard for di 21-time Grand Slam champion wey say e dey feel dizzy as he lost di final to Taylor Fritz.

    Nadal, 35, dey expected to miss both of next month clay court events for Monte Carlo and Barcelona, while di French Open dey start for Paris on 22 May.

    Nadal don win di title for Roland Garros a record 13 times.

    In one social media post, e say wen e return to Spain "I immediately go visit my medical team to do tests afta I play wit discomfort for di final".

    He add say: "As e turn out, I get stress crack for one of my ribs. Dis no be good news and I no expect dis."

    Nadal don be di form player for di world dis year, headlined by im victory for di Australian Open wen e beat Daniil Medvedev for one epic final.

    Im defeat against Fritz for California na im first of di year, wey bring im 20-match winning run to end.

    Nadal no dey expected to fit start practising again for four weeks and im next tournament go be di Madrid Open in six weeks.

  20. Why Asamoah Gyan dey para ahead of Ghana vs Nigeria

    Veteran striker of Ghana national football team don criticize di decision of di kontri coach to drop Majeed Ashimeru from di squad wey go play against Nigeria.

    Di Black stars captain Asamoah Gyan take to social media to call out di FA say e understand why dem leave out Ashimeru from di squad.

    Ashimeru wey dey play for Anderlecht football club for Belgium dey in form and some Ghana fans including Gyan expect say FA for invite am afta e miss out of di 2021 Africa Cup of Nations.

    However, di 24-year-old no follow for Otto Addo 27-man squad wey dem release on Tuesday.

    "I still insist say Ashimeru deserve to dey dis current Black Stars," Gyan post for Twitter.