You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
CHAN 2018: Super Eagles don land for quarter-final
Published
Di home-based Super Eagles of Nigeria don enter quarter-final stage of African Nations Championship after dem beat Equitorial Guinea 3-1.
Na Anthony Okpotu, Dayo Ojo and Rabiu Ali score di goals for Nigeria.
Super Eagles dey lead dia group as dem don collect seven points from three matches.
Dia next opponent na di team wey win second place for Group D.