You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Usain Bolt don 'sign' for football club
Published
Read am in 1 mins
World fastest man Usain Bolt don 'sign' for one football club.
Well, no be real-real football club sha, but im go play for Soccer Aid World XI. Na im go even captain dem sef.
Soccer Aid na charity wey dey bring stars, football legends and ordinary people to raise money so dat more children around di world fit grow up healthy, happy and safe.
Na yesterday Bolt bin make people throat wet when im announce say im go sign for football team today.