You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Liverpool v Arsenal: Reds take Gunners drink garri for 3-1 win
Published
Two goals from Mohamed Salah help Liverpool nack Arsenal 3-1 for Anfield.
Joel Matip bin don open net for first half, afta Arsenal defend deep but allow many crosses from Liverpool full-backs. Na one of di corners wey follow see di defender jump pass im marker to score.
Lucas Torreira score late goal for Arsenal, but by dat time e look like say nothin dem fit do again.
Many go dey wonda how di match for take waka if di Gunners record signing Nicolas Pepe bin score one sweet chance im get for first half.