You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
We no arrest Oby Ezekwesili - Police
Nigeria police don deny claim by Prof. Oby Ezekwesili say dem arrest or even detain her and some members of di BringBackOurGirls (BBOG) Group on Tuesday for Abuja.
Nigeria former Minister of Education and campaigner of di BBOG group bin write for social media say police bin carry her and some members of di group go detention.
Anjuguri J. Manzah di Public Relations Officer of di FCT Police Command say dem just carry dem come dia station to make sure say dem no break any law when dem dey do protest for Unity Fountain, Abuja.
Di FCT Commissioner of Police, CP Sadiq Abubakar Bello tell di BBOG group make dem carry go with dia business.
Prof. Ezekwesili come later tweet say: