You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Burna Boy new album don enter Billboard Charts
Published
Burna boy release di first major album for 2018, 'Outside' and e don already break im former record wey im bin set keep.
Dis na as im start im journey for di Billboard Charts for number 3 for inside di reggae album list.
Dis no go be di first time wey im album go enter di list as im don enter before as di first album for im career L.I.F.E bin enter but bin only rise to di number seven spot for di list.
'Outside' bin comot after di success of songs wey comot from di album like, 'Heaven's Gate'.