You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Cameroon President di celebrate e birthday today
Today 13 February , President Biya don blow e number 85 candle for dis world.
As e celebrate e born day today, President Biya bi take power from Amadou Ahidjo for 6 November 1982, and e don don rule kontri for 35 years.
Na so birthday wishes di pour laik water and Brenda Biya dey among de first pipo weh wish e (papa) president happy birthday.
"Helep me wish happy birthday to loving papa, protector and great Lion", Brenda don tweet.
Some pipo check say president don over stay for power and but e party member dem don di mobilise for put for 2018 election.
University don, John Ako say de birthday concern only president as person, e no get anything for do with de kontri.
But e lament say, "For 35 years weh president dey power, na so-so anarchy, dictatorship, inhuman killing, assassination and prisoner for conscience di show".