You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Nigeria: Herdsmen don attack Ondo local council office, pursue workers comot
Herdsmen don use machete attack at least one local government worker for Ondo state, south-west Nigeria.
Tori be say, di herdsmen and Akure south local government workers dey drag one hot matter wey come enter gear five, sotay di herdsmen pursue di workers comot.
Na only when Ondo State Commissioner of police, Gbenga Adeyanju, and di Commandant of di Nigeria Security and Civil Defence Corps, Pedro Ideba chook mouth for di matter, na im e come finish.
Di Nigeria Union of Local Government Employees don tell government say make dem no let di matter enter palava wey go worse pass.
As things be, di secretariat just dull because many of di workers wey run comot never return.