You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Botswana say make Joseph Kabila step down
Published
Read am in 1 mins
Botswana don tell President Joseph Kabila of Democratic Republic of Congo make in step down.
Botswana foreign ministry say condition for DR Congo dey bad no be small as im "leader don too delay to hold election" and dis one make am no get "control of security for im kontri."
Government soldiers dey always clash with opposition supporters as Kabila no gree leave office.
Na since 2016 dem don dey expect am to step down as im don dey office since 2001 after im papa assassination.
Another deal dey ground with December as deadline for am to handover, but opposition supporters dey suspect say im no go comot.