You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Coachella: Wizkid go perform for di US music Festival
Published
Read am in 1 mins
Superstar Nigerian musician Wizkid dey among di artistes wey go perform for di popular music festival, Coachella for California, US.
Di Coachella Valley Music and Arts Festival aka Coachella na one of di biggest music festivals for US and everywhere for world.
E reach 250,000 people wey show for last year own and di money wey di organisers make reach $114.6 million.
Wizkid announce di tori for im Twitter account:
And of course, bodi begin sweet di fans wey just dey hail am dey go:
Other international artistes wey go perform with Wizkid na Beyonce, The Weeknd, Eminem, Cardi B and Jidenna, wey be Nigerian sef.