You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Lassa Fever don kill person for Ghana
Ghana Health Service (GHS), don confirm say dem don record di first case of Lassa Fever for di country for Tema General Hospital.
Di Director-General of Ghana Health Service Dr Anthony Nsiah-Asare, tell tori people for Accra say, one person don die from di disease.
Dis confirmation come after Noguchi Memorial Institute for medical Research do test.
Im say dem dey do test for all di people wey treat di patient before im die and investigations dey go on to trace all di contacts dem so dem go fit stop di virus make e no spread anyhow.
Dr Nsiah-Asare say make people no fear, say GHS don put things for ground wey go control di spread of di disease.