You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Kids Choice Awards: Emmanuella and Davido get nomination
Published
Read am in 1 mins
Nigerian singer Davido and comedian Emmanuella don collect nomination for di Favourite African Star award for di Nickelodeon Kid's Choice Awards.
Davido post im nomination on top Twitter and im tell people say make dem vote for am.
Even Emmanuella sef post her own for Instagram dey find votes for herself.
Other nominees wey dey di list na Diamond Platnumz (Tanzania) Cassper Nyovest, Caster Semenya (South Africa) and Eddy Kenzo (Uganda).
South African DJ Black Coffee chop nomination for Favourite Global Music Star.
Di 2018 Nickelodeon Kids choice award go shele for Saturday, 24 March