You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Gunmen don kill seven police officers for Abuja
Published
Gunmen don kill seven police officers for Abuja, Nigeria capital.
Di attack happun for Galadimawa junction wey dey along international airport road.
Di Federal Capital Territory (FCT) police commissioner, Sadiq Bello, don confam di tori and say police go release statement.
Di police oga, no give details of how di attack happun.
According to tori, na from inside car di di attackers take shoot di officers dem come drive off.
Dem don carry dia deadi bodi comot from di area.