You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Tanker explosion: Anoda explosion don happun for Lagos bank
Published
Read am in 1 mins
Diesel tanker wey explode cause fire for Ecobank head office for Victoria Island, Lagos.
Di fire happun around 8am wen diesel tanker wey dey offload im product for di bank explode.
Tori be say fire service don land for di area and dem don kwench di fire.
So far nobodi don die, but e no dey clear if anybodi wunjor.
Dis na di second time in one month wey tanker go explode for Lagos afta di one wey happun near Otedola Bridge for Lagos-Ibadan express way for June.