You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Pogba brother: German club reject Mathias to play for dem sake of e too fat
German third tier side KFC Uerdingen don reject France World cup winner Paul Pogba brother, Mathias Pogba because e too fat.
Di 27 year old Guinea born wey don play for Wrexam, Crewe Alexandra, Crawley Town, Seria B side Pescara bin dey on trial for di club to continue e football career dis season, according to local tori pipo Bild.
Dat dream no go go through for Uerdingen now after coach Stefan Kramer think say even though e get good qualities, e need to lose weight.
"Mathias no for fit epp di team, e don go again. Currently e no dey physically fit, im get good physique to be number 9 but e still get too many kilos for im hips." Na so di 51 year old Kramer tok.
Mathias dey play senior professional football for im kontri Guinea. E last play as striker for Sparta Rotterdam for di Eredivisie, Netherlands.
Mathias twin brother Florentin Pogba dey play for St.Etienne inside di French league.