You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Pikin don die for Catholic Church building wey collapse for Delta State
Published
11-years-old pikin don die for Catholic Church building wey collapse for Delta State on Sunday.
Tori be say morning service for di St. Paul Catholic Church, Ugolo, Adagbrasa for Okpe local goment area dey in progress wen di building fall for di head of worshippers.
Delta State Commissioner for Police, Mohammed Mustapha confam di tori give BBC say di building wey fall old pass 100 years.
Make you check back again as BBC Pidgin still dey put eye inside di mata.