You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Lai Mohammed: Nigeria dey spend N3.5m to feed El Zakzaky everi month
Alhaji Lai Mohammed, Nigeria Minister of Information, say di federal goment dey spend N3.5m everi month take feed Ibrahim El Zakzaky, di leader of Nigeria Islamic Movement wey dey dia hand.
Tori pipo Oaks TV na dem release video of press conference wit tori pipo wia oga Mohammed tok dis wan on Wednesday afta Federal Executive Council meeting.
Na for December 2015 Nigerian Army arrest El Zakzaky, afta im followers clash wit army. Since den, im don dey for location wey Lai Mohammed say "dey secret" even though court don grant am bail many times.
Nigerians no chill at all wit dis wan Lai Mohammed tok:
Dis pesin dey wonda which kain food e be:
Dis wan come out wit calculator:
Den dis: