You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Buhari ADC father-in-law don regain im freedom
Published
Kidnappers don release di father-in-law to Nigeria President Muhammadu Buhari aide de camp (ADC).
Kidnappers bin gbab Musa Umar, di Magajin Garin of Daura, for President Buhari hometown for Katsina North West of di kontri for April 2019.
Di IGP Operation Puff Adder Intelligent Response Team join bodi with with police for Kano to carry out di operation for Gangan Ruwa Quarters, Kumbotso LGA Kano State on Monday.
Authorities say dem rescue di Magajin Gari come arrest some suspects with weapons.