You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Davido: 'Blow My Mind' di collabo wit Chris Brown wey pipo no expect
Published
Read am in 1 mins
Nigerian Afrobeats star, David Adeleke AKA Davido go collabo wit American nusician, Chris Brown for new song, 'Blow My Mind'.
Di gist drop for Davido Instagram handle.
Chris Brown bin also share di foto for im handle wit di caption, 'Coming Soon'.
Di song name go be 'Blow My Mind' and even as e neva drop, di news don dey shak fans up and down.