You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Evangelist Reinhard Bonnke don die
Published
Read am in 1 mins
Popular German Pentecostal evangelist Reinhard Bonnke don die at di age of 79.
Im wife Annie Bonnke na im announce im death for Evangelist Bonnke verified Facebook page on Saturday.
For inside di post she say "im pass away peacefully".
Meanwhile Nigeria President Muhammadu Buhari don tell di pipo of Germany, im friends and family sorry ontop di Evangelist death.
For im official Twitter handle di presido tweet say Evangelist Bonnke death na great loss for Nigeria and Aftica.