You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
IBB: Rumour of di former military president death no true - IBB spokesman
Published
Former military President of Nigeria, Ibrahim Badamasi Babangida don come out tok say rumour of im death no true.
Tok-tok pesin to IBB, Kassim Afegbua tell BBC say tok of di retired General death dey "laughable".
On Sunday, rumour begin fly upandan for social media say IBB don die sotay even im wikipedia page also show say e die on 15 December 2019.
Oga Afegbua add say "dis na di third time wey such tori of IBB death go happun for 2019."
Im also release statement wey describe dis kind rumour as part of wetin di "fake news bill" wey Nigeria Senate dey reason suppose torchlight.