You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Lagos resumption of cinemas, spas and gyms take effect immediately but wit conditions
Published
Lagos State Govnor don announce di immediate resumption of cinemas, spas and gyms inside di State afta almost 6 months shut down for Covid-19.
Cinemas must however keep strictly to 33% of wetin dia full size, meaning say na only three out of everi 10 seats dem fit use inside di cinema, Govnor Babajide Sanwo-Olu make di announcement on Saturday.
Dem must get necessary certification from di Lagos State Safety Commission., di govnor add.
More details to follow.