You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Tanzania president burial: John Pombe Magafuli burial fotos of how Tanzania bury dia former president for im hometown of Chato
Di state burial of Tanzania former President John Magufuli dey go on now for im village Chato wey dey for di north-western part of di kontri.
Dem bin do im official funeral for di capital, Dodoma, on Monday and since then im funeral procession don move through di kontri.
Tori be say di 61-year-old president die of heart complications.
President Samia Suluhu Hassan, wey succeed am, go lead di nation during di burial ceremony.
She tweet a thank you note to "everybody wey show support and send condolence messages during dis difficult and trying times for di nation".
See some of di foto dem from di burial ceremony:
Days ahead of di burial ceremony, police bin arrest four pipo for allegedly mocking di death of di former president.
Di regional police head of di south-west region of Mbeya, Urlich Matei, say di suspects intend to "cause chaos and breach of peace".
Di kontri bin suspend all public activities during di 21 days wey dem set for mourning for di president.
End of Di one wey oda users dey read well well