You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Oscar Nominations 2018: Shape of Water get di highest
Published
Dem don announce di nominations for di 90th Academy Awards, and di film Shape of Water, get di highest number.
Guillermo del Toro fantasy romance pack 13 nominations, including best picture.
World War Two drama 'Dunkirk' follow with eight nominations, while 'Three Billboards Outside Ebbing, Missouri' collect seven.
Greta Gerwig collect nomination for Lady Bird, one of nine films wey dem shortlist for best picture award.
Na British actor Andy Serkis and Girls Trip actress Tiffany Haddish announce di nomination for Los Angeles.
Jimmy Kimmel go host dis year ceremony for 4 March for di Dolby Theatre for Hollywood.