You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Thousand Oaks Ca: Shooter don kill 12 pipo for university student night
Published
Read am in 1 mins
E reach 12 pipo wey die afta one gun man enta one bar and start to shoot.
One police officer dey among di pipo wey die for di country music bar wey dey Thousand Oaks, California.
US President Donald Trump don tok say di tin na 'terrible' tin and troway twale give di brave policemen wey enta di mata.
Authorities say na around 11pm local time On Wednesday di shooting start as 200 pipo gada for Borderline Bar and Grill to do university student night.
Officials neva tok who di gun man be and why e do dis kain tin but dem see im dead bodi inside di bar.