'Ebola take away my love' - Survivor tok how pregnant lover die sake of virus

Wia dis foto come from, Don scholar
"Ebola take away my love, e no dey easy at all. " Dis na wetin Chukwuemeka Akagha Dennis wey be software engineer tok as e rememba wetin e pass through di last time wey Ebola enta Nigeria.
Di West African kontri record dia first eva Ebola case for 2014. About 12 years later, Ebola virus enta Nigeria again.
Di Minister of Health and Social Welfare Ali Pate bin confam di informate for statement on Tuesday, 20 October, afta laboratory confirmation.
Di health minister say dem confam di case for di body of one woman wey recently land Nigeria from Uganda.
"Dem admit one woman wey recently land Nigeria on one international flight from Uganda, for one private hospital for di FCT, wia she bin dey received treatment for several days bifor dem confam di diagnosis," di statement tok.
Di woman currently dey in isolation and she dey receive medical care, di statement add.
How victim contract Ebola from first case
Like evri oda Nigerian, Dennis na young man wey wan succeed. Im graduate from di University of Calabar wia e study banking and finance.
Dennis bin dey look forward to building im family bifor Ebola come, wey kpai di lady wey im bin wan marry.
She bin dey infected from Patrick Sawyer afta she contract di infection from am.
"She be one of di pipo wey bin take care of Patrick Sawyer" im tok.
Patrick Sawyer na di Liberia man wey bring Ebola to Nigeria.
"Na wetin I sign up for becos I bin love her well-well." Im tell BBC say dem bin dey prepare to welcome dia pikin bifor she die.
"She bin dey pregnant dat time and I bin neva find out say I dey infected dat time. E bin no dey easy. Di stigma from di pipo around my immediate family.
"I pass through dos challenges and come out of dos challenges. So even wen I bin dey for di isolation centre, I bin dey actually look for pipo wey don survive.
"I bin dey look out for dia testimonies. I bin dey look out for dis positive story dem. I kon dey hopeful say I fit survive."
Im tell BBC say im bin also prepare imsef sake of say im bin don see wetin happun to im wife.
I bin still dey veri, veri hopeful. And wit di whole lot of family support wey I bin get dat time."
How di two lovers meet bifor Ebola

Dennis wey describe dia relationship as "beautiful." tok say im bin meet im late fiancee afta e hear her voice for radio show.
E bin dey hard to reach pipo around dat 2010 and 2011 sake of say WhatsApp and plenti oda trending socail media platforms bin no dey.
"I bin meet her for one radio show. One love radio show. In fact, na popular radio show and becos of her profession I bin also wan marry pesin wey be nurse but no be only dat one, I bin really love and care about her."
Im call her for many weeks but she no pick im call becos her number bin dey busy well-well.
Im tell BBC say dis experience make im mind strong well-well as im no dey fear anytin again. Dennis beliv say if im fit survive Ebola dat time, im go fit survive anytin.
Even though she kpai years ago, im still dey in touch wit her family.
How to prevent Ebola virus
- Wash your hands evri time wit soap and water - Health pipo say make we wash hands wit soap and water and clean surfaces wit chlorinated water.
- No dey touch pipo wey don dey infected - To prevent more of di infection, health professionals advise make pipo avoid contact wit pipo wey dey infected, including for dem to stop to shake hands.
- Avoid deadi bodies
- No dey kill, touch or chop bush meat
- E get vaccine for di Zaire strain of Ebola, wey dey common for di past for Democratic Republic of Congo. And currently no approved vaccine dey for di Sudan strain of Ebola.
- Howeva, early treatment of specific symptoms, fit improve survival of di pesin wey get am.
- For medical teams, dem must wear full Personal Protective Equipment, PPE, wen dem dey attend to cases to prevent infection. Deadi bodi dem, for any body bag, must dey buried by pipo wey dey wear proper PPE.



















