University of Nigeria Nsukka confam death of four students, declare three days mourning

Published
Read am in 5 mins

University of Nigeria, Nsukka (UNN), don confam di death of four students wey kpai for one party wey hold outside di school campus for Nsukka, Enugu State, south east Nigeria.

Vice-Chancellor of di University, Professor Simon Ortuanya for one statement on Thursday, 12 November tok say na 10 students bin dey involved for di incident.

E say di incident wey e describe as "a death too many" happun on Wednesday, 11 November during one party wey di students bin organise to celebrate one of dia friend wey just complete im final-year exam.

Prof. Ortuanya say four of di students kpai afta dem allegedly consume substance wey dem suspect say na alcohol and drugs and di remaining six students currently dey various stages of recuperation for hospital.

Hia na wetin we know about di incident.

Wetin we know about di death of four UNN students

Di Vice Chancellor no identify di names of di students wey kpai and di oda six wey dey receive treatment.

E also no give much details about di party, e only make am clear say na outside di school e take happun for Nsukka and e declare three-days mourning.

"Within these three days, all social and academic activities go dey suspended for di University", Prof. Ortuanya tok.

Di Vice-Chancellor also suspend one town-hall meeting earlier scheduled between di University Community and di govnor of Enugu state.

E also make am clear say di students wey dey involve for di incident na from different department contrary to di tori wey dey spread say all of dem na from di Faculty of Pharmaceutical Sciences.

Di Vice Chancelor sake of di incident don ban all form of signing out celebration for di university and advise students to please stop dey chook hand for things wey go endanger dia lives.

"Graduation suppose be period of introspection, no be time for students to engage for wild celebrations."

Di prof add say di university dey cooperate wit security agencies to expose di actual cause of death of di students.

Earlier, di UNN chapter of di Pharmaceutical Association of Nigerian Students wey confam di death of di four students tok say dem no be dia departmental students.

For one statement wey di President of di association Onah Olisaemeka issue on Thursday, e shed light on di incident.

According to am, di incident happun for End in Praise lodge for Hiltop and di students wey kpai include two males and two females.

Olisaemeka also claim say among di victims wey dey receive treatment for hospital wey im identify, na two "UNN social media personality, wey dey popular for street vlogging and dance content."

Police launch investigation

Meanwhile di Enugu State Police Command don begin chook eye inside di sudden and unnatural deaths of four pipo wey tori identify as students of di University of Nigeria, Nsukka (UNN).

For statement wey di Enugu State Police Command release, wey tok-tok pesin SP Daniel Ndukwe sign on Thursday, also reveal di gender of di victims, but no mention any name.

"Di victims, wey be two males and two females, according to tori fall sick afta dem bin allegedly consume alcoholic beverages for di gathering."According to di police statement dem bin rush some oda students wey also consume di beverage go hospital and four pipo kpai.

"Dem also rush six oda students go hospital for treatment, while dem confam di four victims dead on arrival."

Di Enugu Police Command add say dem recover alcoholic beverages from di place wia di incident hapun.

"Remains of di deceased dey deposited for mortuary for autopsy.

Police wey launch investigation to torchlight dis mata say dem go chook eye well-well to know di circumstances wey dey surround di incident to establish wetin cause of di deaths.

Dem promise to dey update and communicate how di investigation dey progress.

Na earlier on Thursday, tori begin fly for social media about how some students wey go party afta dem do dia graduation sign out kpai and dem from pharmaceutical department.

Fotos wey bin go viral on social media show as some pipo wey dem claim to be di students lie down for ground for unconscious state.

However, dis no be di first time wey sometin like dis dey happun.

Recently, for Araromi-Obu community, some pipo bin kpai afta dem take one dream dem tink say 'na just monkey tail' dem bin dey drink.

For September 2026, dozens of pipo begin die suddenly for some communities for Ondo State.

Dem later find out say no be natural deaths, na somtin dey kill dem.

Dem bin record dis deaths across Odigbo Local Govment Area of Ondo State, southwest Nigeria, wit multiple cases of serious sickness and death wey dem trace to pipo wey consume locally prepared alcoholic and herbal concoctions.

Of all di ova six affected communities, Araromi-Obu, community wey dey share boundary wit Ogun state, na im get di highest number of deaths, according to authorities.

For Araromi-Obu alone, ova 11 pipo die instantly wit ova 50 hospitalised.

Police investigations later find say na one substance dey kill di pipo afta dem drink di locally prepared alcohol mix, dem confam say di substance dey mixed wit methanol.

Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (Nafdac) bin say dem record total of 182 cases wit 48 deaths confamd.

Na ova 100 pipo bin dey hospitalised as five pesin go totally blind.