Wetin to expect from Russia-Africa summit and how e go benefit African kontris

Published
Read am in 5 mins

Di 2026 Russia-Africa summit bin dey gada delegations from about 48 kontris, including 22 heads of state.

E dey happun three years afta di last summit wey happun for St Petersburg for 2023.

Delegations and leaders for di continent already arrive for Moscow, wey dem dey expected to discuss many tins wia dem go host one economic and humanitarian forum for di side.

Organisers also don invite Economic community of West African States (Ecowas) and di Southern African Development Community (SADC).

Russian president foreign policy aide Yuri Ushakov tok say "di aim for dis year summit na to deepen economic, security and diplomatic partnership between Moscow and African kontris".

Among oda tins, di summit dey expected to produce joint declaration afta dem discuss di various trade, food, energy, security and technology issues.

Russia President Vladimir Putin and di African Union chairman wey be Burundi President Evariste Ndayishimiye, go chair di plenary session for Thursday.

Ghana president John Mahama for example go engage for high-level bilateral meeting wit President Vladimir Putin.

"Di two leaders dey expected to discuss key areas of mutual interest, strategic partnerships, and ongoing global developments."

Ghana president like oda heads of state wey go attend di summit, go also engage wit di Russia private sector.

Nigerian Vice President Kashim Shettima go lead di kontri delegation for di summit.

Nigeria Ambassador to Russia Joseph Olusola Iji say "Nigeria want deepen our relations wit Russia and wit Russian businesses".

Bifor di summit go begin proper, Human rights group Amnesty International want make di African leaders speak out against di alleged trafficking of Africans and oda foreign nationals into di Russian military.

Inside one open letter to delegates ahead of di two-day meeting, Amnesty bin ask di leaders to put pressure ontop Russia to end recruitment wey bin dey allegedly exploit foreign nationals economic vulnerabilities to fight for dia war against Ukraine.

"African govments gatz reject any practice wey bin dey treat African kontris and dia pipo like goods for oda kontris political and military objectives," Amnesty tok inside dia open letter.

Dis dey follow one investigation wey Amnesty bin publish for 10 September, wey allege say Russia bin dey use tricks and tori to recruit foreign nationals, including Africans, to fight for dia war wit Ukraine.

Amnesty bin interview pipo between 2024 and 2025 for two Ukrainian prisoner-of-war camps - from Brazil, Colombia, Cuba, Egypt, Sierra Leone, Sri Lanka, Somalia and South Africa

Di Human rights group add say some of di pipo dem interview say dem force dem to sign military contracts wey dem write for foreign language dem no understand.

"For African leaders to keep quiet ontop dis mata go be disservice to di pipo of dia kontris," di letter tok.

Russia don deny running unauthorised recruitment programmes. Dia Foreign Minister, Sergei Lavrov, don maintain say foreigners wey bin dey join di kontri armed forces bin dey join for dia free will, according to Russian law.

According to Ukraine Coordination Headquarters for di Treatment of Prisoners of War, dem identify about 28,000 foreigners from 136 kontris wey don dey fight wit Russian forces as at April 2026.

Russian state media don also allege say Ukraine recruiters also don dey try to use style and tricks to recruit foreigners.

Which kontris dey attend dis summit

For di 2023 summit, 49 delegations bin attend wia 17 heads of state bin take part.

Di Kremlin dey expect say di participation for dis year go increase.

Even though authorities no list all di delegations and heads of state wey dey attend di summit, e dey expected say leaders for dis kontris dey attend di summit.

  • Burundi
  • Zimbabwe
  • Mozambique
  • Equatorial Guinea
  • Ghana
  • Mali
  • South Sudan
  • Eritrea
  • Republic of Congo
  • Egypt
  • Uganda
  • Rwanda
  • Algeria
  • Burkina Faso
  • Ethiopia
  • Nigeria

Wetin happun for di last summit for 2023

Afta 59 panel sessions wit 457 speakers for four areas for di 2023 summit, di forum bin sign 161 agreements.

Even though dem neva tok di value of di agreements, most of dem na humanitarian cooperation for di following industries:

  • International and interregional cooperation – 56
  • Education and science – 51
  • Scientific and technical cooperation – 10
  • Exports and foreign economic activity – 10

E dey expected say di 2026 edition of di forum go sign more agreements and partnerships.

African leaders go hope to use di summit to highlight some of di challenges wey dey face dia kontris and pursue ways to get support across many sectors.