You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
UK to announce changes to rules around permanent residency for migrants - Wetin to expect
- Author, Iain Watson
- Role, Political correspondent
- Author, Toby Mann
- Published
- Read am in 3 mins
UK Home Secretary Shabana Mahmood dey expected to announce her final decision for immigration rules for legal migrants on Monday, 2 November.
She bin don propose to increase di wait period for pipo to get permanent settlement from five years wey e be now to 10 years. For some lower paid migrants, dem dey look 15 year wait.
Di BBC understand say di proposals dey revised for most of di pipo wey currently dey work for social care.
Di home secretary dey worry about di number of pipo wey go dey eligible for permanent residency afta a period of very high net migration under di previous govment.
Mahmood don face opposition from inside di govment say she dey propse to impose new rules for immgrant workers wey don dey inside di UK alreadi.
Bifor she go back cabinet, Housing Secretary Angela Rayner bin call di proposals as "un-British" bicos dem wan change rules on top pipo wey enta UK in good faith.
Most especially, many lower paid social care workers go dey face wait of up to 15 years instead of five years.
But di BBC dey hear say social care workers wey alreadi dey di UK fit dey left out of di longer wait period.
End of Di one wey oda users dey read well well
But as dem bin originally plan am, e go dey possible say most of di oda workers go need to live and work for UK for 10 years bifor dem fit dey eligible for permanent settlement.
E fit dey reduced if dem contribute to dia local communities or start to dey make more money.
Si govmen consultation on di proposed reforms don alreadi get 200,000.
Di Home Office no go tok pim on Mahmood final decisions till dem carry am go meet parliament.
For September, Conservative tok-tok pesin say, "Shabana Mahmood don bend for pressire of Angela Rayner and ger open borders MPs and go tear her own plans to reform idefinite leave to remain".
Di pesin add say, "dis na slap to di face of British taxpayers wey go need subsidise low-skilled, low wafe migrants."
Permanent residence, or indefinite leave to remain, na wetin dey give pesin right ot live, work and study for di UK as long as dem want. Dem also fit apply ofr benefits wey dem qualify for.