Papa of 15-year-old Ghanaian boy wey dem kpai for US describe how dem bully am as Ghana condemn killing

Published
Read am in 4 mins

Di papa of Ghanaian teenager Javits Frimpong don describe how dem bully im son bifor dem kpai am for di Bronx borough of New York City, United States.

Dem shoot and kpai Thomas Frimpong 15-year-old son wen e bin dey go school on Thursday, 29 October.

Police officers bin rush am to St Barnabas Hospital, wia e later kpai from im injuries.

Authorities dey search for three teenage suspects, wey dem believe to be between 16 and 18 years old, wey reportedly run comot from di scene wearing black clothing and blue surgical masks.

Police neva announce any arrest, while di motive for di shooting remain under investigation.

Di victim papa, Thomas Frimpong, believe say bullying wey im son allegedly experience for school fit dey connected to di killing.

"E no easy, e no easy. I dey here wit im. E just reach one year wey e come from Africa. Na yesterday e reach one year for here. E no dey tok, e dey quiet, e no dey tok, e dey always dey on im phone," Thomas tok.

"Di principal tell me say two guys dey disturb my son and say e don suspend dem. E say my son dey innocent and e dey school."

Thomas say im son tell am say anytime wey im dey go for lunch, one of di boys dey always dey bully am.

Di killing don leave residents of di neighbourhood shocked, and some dey raise concerns about violence wey involve young pipo and call for more programmes to keep teenagers engaged in positive activities.

Meanwhile, di govment of Ghana don express condolences to di family of di young boy.

Ghana Foreign Affairs Minister, Sam Okudzeto Ablakwa, disclose dis inside one statement, wia e tok say e don tok to di victim papa to convey di condolences of di Ghanaian govment and pipo.

E say officials of Ghana Permanent Mission for New York don visit di bereaved family and dey coordinate wit local authorities.

According to Ablakwa, di Foreign Ministry go work tirelessly wit US authorities to ensure justice for di deceased.

"Di family of Javits and im loved ones remain in our thoughts and prayers," di minister tok.

Ghana govment urge relevant authorities for di Bronx, New York, to conduct thorough investigation and ensure say dose wey dey responsible face justice.

Gun violence remain major public safety and public health challenge for di United States, as tens of thousands of pipo dey die from firearm-related injuries evri year.

Di widespread availability of guns, differences in state firearm regulations and disagreements ova gun ownership don continue to shape di debate about how to address di problem.

Di US Constitution Second Amendment protect di right to keep and bear arms - pipo wey oppose stricter gun control dey cite dis provision well-well.

However, advocates of tighter regulations argue say stronger background checks, safe-storage requirements and restrictions on access to firearms fit help prevent deaths.