Five tins to know as Ghana authorities prepare for Ebola

Published
Read am in 5 mins

Ghana health authorities don dey step up checks for dia airport as dem dey prepare for any possible Ebola importation for di kontri.

Dis dey happun weeks afta Nigeria confam dia first case since di May outbreak for DR Congo.

Di Central African kontri bin record ova 10,000 cases wit almost 5,000 deaths.

At least 2,600 pipo don also recover from di disease wey currently no get vaccine.

But already, Nigeria govment don release ₦10bn ($6.7m) in emergency funding to support laboratory testing, purchase protective equipment, mobilise health workers and strengthen oda containment measures, afta di kontri confam one case of Ebola virus.

Nigeria minister of health Prof. Muhammad Ali Pate wey give dis informate for one interview wit di BBC add say, medical personnel across di kontri also dey receive additional training in anticipation of different outbreak scenarios.

Na so Ghana bin dey step up dia own preparedness, even though dem neva record any case of Ebola.

Ebola prevention measures by Ghana

Ghana health minister Kwabena Mintah Akandoh bin visit di airport to check some of di tins, wey im tok say make pipo no panic.

Ghana already dey welcome visitors and oda pipo wey don dey prepare for Detty December and oda tourism activities.

Di kontri gatz dey alert to find any suspected cases and deal wit am quick bifor e go turn ogbonge wahala.

part of measures wey Ghana authorities don set na di triage area.

Di Triage area go allow authorities to examine pipo for di airport if dem pick up some signs of sickness

Installation of thermal scanners Ghana international airport

Ghana health minister say dem don install scanners wey go help dem screen passgengers for di airports.

E mean say as visitors dey enta Ghana, dem go dey subjected to screening by scanners.

"We don install dis scanners wey go help to screen passengers wey dey enta di kontri and support contact tracing if dem find any case," Kwabena Mintah Akandoh tok journalists wen im tour di facilities for di airport.

Laboratory testing and isolation facilities dey ready

Di minister explain say di kontri don improve dia laboratory capacity wey go support testing and diagnosis of Ebola cases.

E explain say di kontri get di Kumasi Centre for Collaborative Research (KCCR), Noguchi memorial institute for medical research (NMIMR) and di national reference laboratory.

Oga Mintah Akandoh also add say di kontri bin get infectious disease treatment centre wey go support isolation and management of patients if di virus enta di kontri

Use of electronic declaration forms

Di port health section for di Accra international airport don deploy electronic declaration forms.

Dis form go help Ghana take determine di health condition of any visitor wey dey enta dia kontri.

Passengers gatz fill dis form wey go help authorities to assess dem and trace contacts quick quick if any suspected or confam case don show.

Di form go get details wey go help authorities trace individuals if dem need to.

Avoid touching and selling animals wey sick or die

Di Ghana Health Service don alreadi begin dey educate pipo and warn citizens against wild animals, wey dey transmit Ebola.

According to di World Health Organisation (WHO), Ebola fit dey transmitted to human being thru contact wit infected wild animals wey include fruit bats, monkeys, chimpanzees, gorillas, forest antelopes and porcupines.

Na so Ghana authorities warn say make "pipo no touch, move, sell or give away animal wey don dey sick or animal wey die."

Report sudden death of animals

Authorities also tok say pipo gatz report cases of dead animals to di nearest veterinary office - dis include sudden death or death wey dem no fit explain.

"To report early and to dey act responsibly fit protect you, your community and di entire kontri," di Ghana Health Service add.

In addition to dis warning, authorities continue to dey advise pipo to wash dia hands regularly wit soap under running water or use alcohol-based hand sanitizer.

Dem also dey ask pipo to avoid contact wit body fluids; na so trained care workers gatz use appropriate protective equipment.

Also if pesin get fever, headache, muscle pain, chills, vomiting and unexpected bleeding, di pesin gatz visit di nearest health facility immediately.

Wetin oda kontris dey do

Many kontris for di region don begin to tighten dia surveillance and screening.

One man who came into contact with the man who died in Kenya is under quarantine in Somalia and samples have been sent to Kenya for testing.

As at 26 October, Kenya bin get total of nine confam cases, wey include two deaths.

Dis dey link to di first case na so dem report di last case for 20 October 2026, according to di European Center for disease Prevention and Control.

Somalia don also tok say dem bin dey take precautionary measures, wey include enhancing surveillance for di kontris borders.

Di suspected case for Somalia bin travel through Ethiopia, wey don also tok say dem bin tighten surveillance to prevent outbreak.

For Tanzania, visitors dey expected to undergo daily health monitoring for 21 days, through one automated tracking system, wey dem bin announce afta Kenya confam multiple cases of di Ebola infection.

Uganda tok afta Kenya first confam Ebola case say dem bin dey continue it was to "maintain strong surveillance measures to protect public health".

Di Cameroon govment bin tok say dem also increase surveillance to prevent Ebola.

Minister for Public Health, Dr Manaouda Malachie for 22 October tok say make pipo neva panic.

"We no get any case for Cameroon yet, we just dey prepare ourserf, our equipment and our logistics wey go help us isolate and provide care."